Be it traveling within or beyond the shores of 9ja, there's always an experience. It could be silly, absurd, strange, bizzare or outright funny. Here is where to share your experience in Pidgin; the language wey we take drive oyinbo people comot for our territory.
Me and my friend go Chinese restaurant aka Chinko buka. As we reach na, we tell dem for counter say na to go so dem carry white container give us. Plenty time you no say na buffet but as we no go stay we begin carry dis, join dat, after all if na for here we go chop till we belle full. We load our container so tay container hard to close, na so we talk say e don reach; variety don climb climax.
As we reach counter, the Chinko lady no even talk plenty grama she just collect our container, weigh am and talk our price (?). Sho! Na so we begin look each other like lookee tee. Chinko wayo! Why dem no tell us say for here na constant to go na weigh. Anyway, as we get change for pocket we kukuma pay come carry our overloaded container follow body.
My people, if you get tory talk am here...
Monday, October 8, 2007
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment